E-money arrest: Why EFCC arrest Lagos socialite Emeka Okonkwo for alleged foreign currency abuse – BBC

Spread the love

Wia dis foto come from, iam_emoney1/Instagram
Di Nigeria anti-corruption agency di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don release popular businessman, Emeka Okonkwo alias E-Money, after im arrest ontop allegation say e abuse di naira and foreign money.
Reports say dem release E-money on Wednesday and dem go charge am to court soon.
Oga Dele Oyewole, tok-tok pesin of EFCC bin confam di arrest of E-Money to BBC News Pidgin on Tuesday.
Di socialite dey face allegations of foreign currencies abuse, linked to im alleged act of spraying US dollars, dis dem say violate di Foreign Exchange Act.
Di alleged currency spraying reportedly happun for one party for Lagos, Nigeria commercial capital.
Di commission arrest am for Omole area of Lagos and dem bin fly am to Abuja, to charge am to court as soon as dem conclude dia investigation.
E-Money arrest na one in a recent clampdown of ppo wey abuse money wey some celebrities don fall enter.
Recently, Federal High Court for Lagos also remand hip-hop musician Terry Alexander Ejeh, wey pipo sabi as "Terry Apala," for di Ikoyi Correctional Centre, Lagos for di for alleged mutilation of di naira notes.
Di commission arraign Ejeh biforJustice Akintayo Aluko on one-count charge of abusing naira notes during one social event at Madison Place, Oniru, Lagos Island.
Di defendant plead not guilty to di charge, upon which di counsel to EFCC ask for trial date and di remand of di defendant in di custody of di Nigerian Correctional Centre.
For April 2024, di hand of di law bin touch Idris Okuneye aka Bobrisky ova accuse say e abuse di naira wen e dey spray am for different parties.
Bobrisky accept say im dey guilty to di offence of naira abuse wen di judge ask am if e dey guilty of di allegations.
Na EFCC bin carry Bobrisky go court initially over di case of money laundering and spraying of naira notes wia dem sama am wit six count charges.
However, Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Ikoyi sentence Bobrisky to prison for naira abuse afta e plead guilty.
Last year, court also grant club owner Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest bail.
Dis na afta e plead not guilty to di charges wey di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC sama am ova naira abuse.
Cubana Chief priest bin appear for di Federal High Court for Lagos for April 2024 – den later get bail wey worth about N10 million wit two sureties.
Section 29(1)(a) of di Foreign Exchange Act tok say anybodi wey defraud, forge, mutilate, utter or deface any foreign currency, dey guilty of offence.
Pesin wey court find guilty of dis offence fit serve five years for prison or court fit fine am five times di amount of foreign currency wey dey involved.
And if di matter concern a company, di company go pay fine of ten times di amount of the foreign currency.
Also, Sections 21 of di Nigeria CBN Act, 2007 make am crime for pesin to abuse di naira. Offenders go serve six months in prison or N50,000 fine.
For dia website, di CBN list wetin abuse of naira mean. Dem include: spraying, writing, stapling, tearing, soiling (dancing on or stamping on the Naira notes), sale, and mutilation.
High Chief Emeka Okonkwo, wey pipo sabi as E-Money na Nigerian entrepreneur, investor, and philanthropist.
Dem born am on February 18, 1981 for Ajegunle, Lagos. E-Money journey from entertainment industry.
E-Money na di CEO of Five Star Music, a record label in Nigeria, and Five Star Oil and Gas, we be energy company.
E-Money marry Juliet Okonkwo and dem get three pikin.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

This will close in 0 seconds